|
MOLARA WOOD
BRODA
I look for man for up I look for man for down I look till I tire for waka From Naija to Bahia.
Dem say when una look una find Dem say una find when una look Seek ye shall find, na so Bible talk So broda, why na you I find?
Una no good for go Una no good for come Una no good for anything Una useless pass stone.
Na broda dem call una, Abi na aburoda? Whatever una call yaself I don pass weak for una
Broda, abi na garawa? I no wan see una for hia Pack ya cloth, dey go No forget ya shoe.
No send me ya papa I no wan see ya mama I no wan see di family committee I no wan see ya shadow.
Broda, broda, comot for hia Wey una like, make una go Comot patapata, no return to hia Mista, I beg una, bo sita.
I look for man for up I look for man for down I look till I tire for waka From Naija to Bahia.
Dem say when una look una find Dem say una find when una look Seek ye shall find, na so Bible talk So broda, why na you I find?
© 2004 Molara Wood
Next Page
|
|